Nations Cup: Eagus allow lead to kpafuka again


Football Tori For Pidgin




De game na dia sekond group C game as na 1-1 draw na im de Naija team take start dia campaign against Burkina Faso.

Na Zambia wey na dem be de current Afcon champions wan shock Naija fans for de 16minute wen Kalaba face Naija goalie, Vincent Enyeama but de guyman troway de chance.
De refiree con give Naija penarity for de 26 minute and Mikel wey dey tap him futball for Chelsea for Ingland no score de kick for Naija.

Chizamba wey be Zambia strika take style test Naija goalie, Enyeama but de goalie dey kampe as him take hin left hand save de ball.

Mikel wey don miss penarity for Naija come dribu two Zambia playas befor him carry de ball give Emmanuel Emenike and de guyman finish de Zambia goalkipa as him score de goal for Naija in de 57th minute.

De goal wey Emenike score na him sekond goal for dis 2013 Afcon tornament as na him score de goal for Naija for dia fess game wey dem draw 1-1.

Gbege kon happen again for de die minute as de refiree blow a penarity for Zambia at de time wey Naija pipu and fans don dey happy say de Eagus don win.

Zambia golkipa, Kennedy Mweene run come from de back and him score de penarity wey Enyeama no get ansa for at all.

Supa Eagus of Naija go qualify for de kwatafina of dis 2013 Afcon if dem beat Ethiopia wey go be dia next enemies next Tuesday.

Comments